Tuesday 26 May 2015

SAKORDIE PAY ACEHOOD $25K FOR THE COLLABO?

Remember I bring una gist say Ghana rapper Sakordie and Acehood dey work on song together, wahala don happen Oo.
Sakordie go Ghana go talk say na Acehood meet am so that dem go do the song together, but e be like say na lie.

Acehood go hin instagram to deny the tori say Sakordie na hin come meet am for the collabo and ontop that one hin still pay am $25,000,000 for the song.
Sakordie wey don shoot the video with the DJ khaled recording label artist never yarn anything about the tori. Fans don dey yarn about the matter say Sakordie too dey praise himself and e no good.
I pray say dem go still release the song but $25k for collabo nawa oo.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.