Sunday 23 August 2015

WE DEY COME BACK!!

We promise Una say the website dey comot and we dey happy to tell Una say for Oct 1 we go leave this domain as we go to our full website. We thank for the support. God gp bless Una!! No forget October 1.

Monday 17 August 2015

PHOTO: FOOTBALLER VINCENT ENYEAMA SHOW SAY HIN BE GOOD HUSBAND

Vincent Enyeama ysterday post this picture for Instagram as hin dey clean hin house for Framce. the Lille goalkeeper for the French league for there come write say hin dey clean the house because hin house keeper dey on vacation and hin wife dey free weekend.

Sunday 16 August 2015

FOOTBALLER CRISTIANO AND SON SHOW DEM SIX PACKS



Like Papa, Like Pikin!

WHY? BOVI YAB FAN WAY TALK SAY HIN STEAL ALIBABA JOKE



I just dey waka my own for Instagram as I dey do my normal Amebo work when I see this one. This fan talk say when Bovi thief Alibaba joke nobody talk but when AY thief Bovi own we no hear word. Bovi come reply am for way wey I no like and I feel say e no good for celeb. Trust Naija people, the girl sharp sharp reply Bovi.

IF TO SAY KOREDE NA WOMAN..... NA SO HIN GO DEY

I no fit stop to laugh, Naija people una wicked.

NAIJA RAPPER KEMISTRY TALK SAY SHE DEY PART OF VOGE MAGAZINE SEPTEMBER COVER


The rapper post this picture for Instagram come talk say she never believe say she dey the picture. I no understand, na she dey the painting? You see anything?

SINGER ASA SHOW OFF SEXY LEG FOR LATEST PICTURES

Asa no dey show her body everytime so when we see something like that we dey always dey happy say we see am. The singer wey dey based for France but e be like say she don come Lagos now decide to bless us with this picture.

PHOTO: FUEL TANKER WEY GET ACCIDENT FOR LAGOS- IBADAN EXPRESSWAY TODAY


This one just happen this afternoon and I too know Naija get the first pictures. The tanker just get accident come turn upside down. According to wetin I hear, some people wey dey there don go there to dey thief fuel from the tanker. I just pray say make the tin no explode for dem body. 

ACTRESS YVONNE JEGEDE FORGET HER BRA FOR HOUSE?


The actress for this occasion for lagos last week wear this yellow gown and to me I believe say she no wear bra. The actress dey popular for the way she dey show her breast and cleavage. Weti  una think?

SO YOU THINK SAY YOU SABI PIDGIN?


So some of una think say pidgin English na simple tin to write. Oya make una try to change this english tin to Pidgin English. Make una change ' It is irrevocable' to Pidgin English. Simple abi, oya change am.

I BIN THINK SAY MY HUSBAND AND KCEE NA TWINS--- E-MONEY WIFE


Kcee brother E-money and hin wife Juliet yarn with PUNCH Newspaper for new interview. When dem ask Juliet wetin she think about her husband when she first see am she yarn say she think say hin and Kcee na twins.
' Hin and Kcee resemble well well, so I think say dem be twins. i like am when we first see and we bin start as just friends. We bin date for four years and from there we decide say e don reach time make we marry.'

PHOTO: SINGER DAVIDO MEET MALI PRESIDO, IBRAHIM KEITA


Naija musician, David Adeleke wey una know as Davido visit Mali Presido Ibrahim Kaita for the state house for Bamako. Davido wey be 22 years old dey Mali for perforrmance and fit perform for front of one of the biggest crowds for hin life. Davido na big boy oo. 

35 YEAR OLD SINGER WAJE DEY LOOK SEXY FOR NEW PICTURE

 U na think say Waje go still marry? She be 34 years old and she go be 35 for September 1 this year. The 'Coco baby' singer get one fine daughter Emerald, and even with her age she still dey look fine. Waje start t dey popular after Psquare use her voice for dem song 'Do me' and she talk say she cry when she no dey dem video for the song.

BISHOP OYEDEPO AND HIN WIFE CELEBRATE 33 YEARS OF MARRIAGE

Bishop Oyedepo wey be the General Overseer of Living Faith wey many people know as Winner's chapel announce today for hin church service  say hin and hin wife dey celebrate dem 33 years of marriage. Hin share the tori as hin dey pray against the spirit of divorce for marriage. Congratolovia to dem!

E DON DO!! THIS NA MAHEEDA WORST PICTURE

NO behin be this o
Maheeda don finally go mad and this time she dey show here anus. Una know say me I no like to hide anything but this one too much say I no fit even show am for the home page. Look the picture after the break. No open am if you dey church.