Tuesday 4 August 2015

JONATHAN FIGHT ME AFTER HIN INCREASE SUBSIDY MONEY TO N1.9TR



Former Rivers state Governor Rotimi Amaechi don yarn say for former Presido Goodluch Jonathan timee, hin Increase the money for Subsidy from N300b wey the tin suppose dey to N1.9tr. Amaechi yarn this one as hin dey follow news people dey yarn.

After 6 months wey Jonathan take over hin increase the money wey Naija dey spend for Subsidy from N300Billion to N1.9tr and hin no even ask or tell anybody. Hin yarn say Subsidy money na N300Billion under former Presido Olusegun Obasanjo and the tin even continue under Shehu Yar'adua.

E get one time wey I jam Jonathan and hin people for one meeting and the meeting be say dem wan increase the Subsidy money again. As Chairman of Governor's Forum I tell dem no say e no good and say I no go support dem.
 Amaechi come yarn say hin tell dem say the matter still dey Court and now dem wan start another Subsidy. I respect former Presido Jonathan but the tin wey I no agree with am na the way hin dey follow bin dey handle all the money wey dey for the country.


No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.