Tuesday 26 May 2015

BUHARI SHOCK GOVERNORS, YARN SAY HIN GO CHOOSE HIN MINISTERS BY HIMSELF

For weekend, GMB shock all the governors wey think say na dem go submit names of ministers wey go dey the new government wey dey come.

Hin yarn say hin government go be for only professionals wey get experience and hin no go do like former PDP presidents wey dey collect the name of ministers from governors before screening for national assembly.
Buhari still yarn say hin fit comot subsidy from petrol for Naija because of the wahala wey the tin go cause.Hin yarn say hin go fight corruption and mago-mago for that sector for we country.
The next presido wey dem go give power for May 29, talk say hin government go put education, employment and security matter for dem plan as dem start government.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.