Friday 24 April 2015

CHOCOLATE CITY OGA AUDU MAIKORI EXPLAIN WHY HIN DEY RESIGN

Yesterday I bring the tori say Chocalte City Oga Audu Maikori go soon resign as President of Chocolate city music  here. well hin don explain wetin make am resign.

Hin talk say hin just dey step down from Chocolate city music. Audu talk say hin still be the CEO of chocolate city group wey hin get with hin friend and brother. Hin talk say why hin dey step down na so that person with new ideas go take over.


Anyhow, tori don dey say na M.I wey be Chocolate city vice presido and the owner of loopy music wey don join Choc city go take over.
Read more tori  here 


E-more

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.