Friday 17 April 2015

JIMI AGBAJE TELL HIN SUPPORTERS MAKE DEM NO FEEL BAD

PDP governor candidate for the last election Jimi Agbaje don tell all hin supporters say make dem no feel sad say him no win the April 11 election wey dem do for Lagos.

Hin talk say instead make dem happy for the decision wey dem make and make dem make sure dem continue to work hard make Lagos for beta.
Mr Agbaje talk this one for hin official Facebook page,hin talk say Whether na win or lose the tin be sat Lagos go beta and everybody fit talk say dem don contribute dem own to Lagos.
Mr Agbaje don talk say hin no go contest for Governor election for Lagos as hin no get good feeling about the potential wey Lagos get.


E-more

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.