Friday 17 April 2015

I GO PERFORM GODWIN FOR CHURCH AGAIN!----KOREDE BELLO

Last week many people dey yab Mavin Records artist Korede Bello wey go perform hin hit by track "God Win" for Harvesters International christian Church"(HICC).
Korede Bello don talk say him no go regret am and if another chance come make hin do am,hin go do am again.
See wetin Korede talk:
"If you be pastor, and you invite me to perform the song. I go perform am.Yes,I go perform the Song again (for church).Na God song,wetin matter be say the song dey talk about God.From when I get the Song, I know say no be my song and I know say anything wey be say na God get am,go grow pass as you plan.
The song no be Gospel song,na inspiration song.The song na for God I write am.No be my song. The song na for people and I look am as song for God.


E-more

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.