Monday 13 July 2015

NFF NO FIT ANNOUNCE OLISEH AS SUPER EAGLES HEAD COACH ON WEDNESDAY--- FG


FG through National sports commission don write letter give NFF say if dem try am say dem wan Sunday Oliseh, Super Eagles work on Wednesday dem go stop am. Dem yarn say NFF no follow the law wey dem suppose follow before dem carry the work give Oliseh.


According to NSC the position fpr the coach of Naija senior team still dey available as dem no recognise Oliseh as the coach until NFF do some tins wey dem suppose do and follow the law. If NFF announce Oliseh as the new coach on Wednesday, dem go stop am as NFF no follow wetin dem call 'Procurement Act'

Wetin NFF suppose do na to write Letter give NSC to yarn dem say dem wan cjoose another coach for Super Eagles and if dem no wan advertise am dem go just choose some people wey go bid for the work. If na Oliseh dem want, dem go write letter give NSC to explain why na only am dem want for the work. As I dey like this NSC no know whether NFF dey announce any new coach this week because nobody don tell us anything, One man wey dey work for NSC yarn Guardian Newspaper.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.