Tuesday 9 June 2015

5 THINGS WEY YOU KNOW ABOUT BUHARI TRIP TO G7 SUMMIT



Look some things about this Buhari trip to Germany for the G7 summit meeting.
1. This na the presido first trip outside Africa since hin become presido and na hin first meeting with UN secretary-general Ban ki moon.


2. Naija no dey part of the G7 but dem invite naija and Iraq wey terrorist problems.

3. Fashola and Fayemi wey be the two main candidates for Chief of staff follow presido Buhari. Fayemi go before Buhari and the other 20 people wey follow am.

4. The members of the G7 ask presido Buhari to bring the list of wetin and hin want make dem help am do, and security na the number 1 for the list.

5. I no get any last one except, President Buhari tall pass all.the leaders for there.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.