Saturday 23 May 2015

NAWA! DEM BURN OLD WITCH FOR KEBBI STATE

This country sef?
People for Arungungu for Kebbi state don burn one old woman wey dey talk say na witch till she die.
Kebbi stare commissioner of police Danladi Mshelbwala yarn say the time wey police reach there, the woman don die and no only the Ashes and some parts of her dead body remain.

Police no talk the name of the Woman but the people for the village yarn say the woman dey come their house, dey thief dem souls.
The one wey dey beg according to dem dey use scope dey carry dem souls go.
Police don start investigation and dem go arrest the people wey do am
Nawa oo

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.