Sunday 24 May 2015

BUHARI GO NEED N4.1tr FOR SALARY,ETC

APC National chairman, Chief John Oyegun don yarn say next presido, General Muhammad Buhari go need N4.1tr for salary and other tins wey hin go spend money.

Chief Oyegun yarn this one as hin dey follow all the APC senators wey win the last election for dem states on Saturday.
Hin yarn say Buhari go need the money to pay the salary of civil servants for State and Federal levels, Fuel subsidy and other loans wey the country dey owe.
Hin yarn say make the senators dey ready to make laws sharp -sharp , wey go help the country.
The Party chairman congratulate dem for the last election and how dem win but make dem dey ready to work.
"Even though we want make tins happen, we no fit promise say the tins say the tins go happen over-night". E no go dey easy because Naija don suffer bad government for the past 30 years.


Tori from THE PUNCH

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.