Sunday 24 May 2015

FUEL SCARCITY WAHALA PT 2

When dem discover oil for Naija for Olobiri for 1950's, many Naija believe say our suffer don end and many people get hope for a better Naija.
Yes!, we no fit use naija of that time compare today but wetin many people tink say go be our blessing don turn to Curse and our biggest problem.

Almost 60 years after dem discover oil for Naija, our filling station dey like grave yard and the ones wey get na another Oshodi market. E don reach say our Darling radio stations, Telephone network services don dey close down because dem no fit see "Diesel" buy.
Nobody dey talk! the oil marketers dey blame, nobody dey talk! the government don quiet. The people dey suffer! transport money don double, the people dey suffer! dem dey sleep for filling station.
The next government wey dey come dey blame the one wey dey now, yet we dey hear say dem wan use about N2B for the May 29 inauguration. Oil wey dem dey call Black  man gold don turn to the black man master and our people don turn to slave for am.
This week wey dey come, our people fate go dey the hand of two people.
1. The transporters wey go call anything dem like because of the suffer wey dem use get the fuel and the price wey dem buy am.
2. The government: we just pray say the meeting between oil marketers and the ministry of Finance on Monday, May 25 go bring beta fruits, as from wetin we see the new government no wan carry this fuel wahala.
So, if this tin no end this week, Naija people go wait till the new government finish all dem party and celebration, settle down before dem go face this fuel wahala. We just pray, say e no go reach that one.
I pray this na the last tin I go write about this fuel wahala and buy next week the fuel wahala go don end.

Etim Imoh.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.