Sunday 24 May 2015

APC WIN 22 OUT OF 23 COUNCIL FOR LGA ELECTION

APC candidates don dey lead for 22 out of 23 local government areas for Rivers state local government election wey happen yesterday.
The election wey many people yarn say na free and fair no get many voters because of the rain wey start around 6 a.m for the state.

The election no hold for Ogba/Ndoni/ Egbema area for the state because dem election na next year.
Election start proper in the afternoon after the rain as people comot for different polling units.
RSIEC go soon announce the official result even though the APC dey accuse PDP say dem lie to the people. The PDP wey carry RSIEC go court but since dem postpone the case the election go still continue  but the PDP go dey tel voters say dem don cancel the  election.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.