Thursday 30 April 2015

SEE AS ALIBABA DEY YAB ME FOR TWITTER

So yesterday April 29, I write say Alibaba don buy purple truck
 here  come tweet am to Alibaba for twitter. After 2 hours I go my notifications only to see say hin dey call.me olodo blogger say I no know wetin I dey do say hin don buy the truck since 2008.
My people if you check that post well I write say I no sure whether hin just buy am but the truth be say hin buy am na wetin I write be that.
Alibaba you be my mentor and the fact say say you look my side make me happy.  You dey follow me for twitter you for just send me direct message. I remember when you talk say you no go join politics I send you direct message to confam am before I post am.
I still respect you and I hope say we go work together one day.


E-more

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.