Friday 21 November 2014

EMMANUEL ADEBAYOR TROWAY IN MAMA FROM HOUSE CALL AM WITCH AND NOW IN DEY DENY

news wey reach me talk say Tottenham Hotspur Striker and Togo Captain Emmanuel sheyin Adebayor drive in Mama comot from in House. Adebayor wey people sabi for in charity no get better relationship with in family.den talk say in comot in mama from the US $1.5 million house wey in buy from in family. den talk say in talk say in family dey do juju for am and in mama na witch.

Adebayor deny the news when  in talk to peace FM. make i tell una wetin in talk for pidgin.  in talk say in no be pastor so in no fit talk who be witch .
 in talk say in mama leave by herself and in no fit use in bouncers drive in mama from d house.
in con talk say no be only am tge mama born so then suppose share am
see wetin in con talk again  say den share in house and in property dey wait make in die.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.