Saturday 8 August 2015

E DON REACH TIME TO GO BACK TO FARM---- BUHARI


Presido Buhari don yarn yesterday, Friday July 7th,2015 say e don reach time say make Naija people ready to go back to farm again. Hin yarn for Abuja say hin own government go take Agriculture very serious so that dem go fit carry Naija go front.


The presido yarn say to dey export crude Oil and gas no go fit continue as the way Naija go dey make money as dem need other ways and Agriculture na one of the ways dem fit make money too. Presido Buhari wey dey talk about hin campaign promise when hin talk say hin go beta farmer's life. Hin talk say before Farmer's get help from government hin go comot all the long-long tins wey dem suppose do before dem see government as na so the tin dey before.

We campaign well well about Agriculture and now we dey ready to help farmers and help anybody wey we wan go inside farming for Naija, hin talk.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.