Saturday 1 August 2015

ACTRESS GLORIA YOUNG EXPLAIN WHY SHE FIGHT BECAUSE ON N20,OOO FOR BANK

Actress Gloria young, Norbert Young wife explain why she go cause wahala for bank because of N20,000. Read am after the break.

I go use ATM for Ejigbo side for lagos near NNPC filling station for December last year, I go withdraw N20,000. The machine no gree bring out the money but I collect alert say dem don comot the money from my account. I go the 2nd machine and the tin pay me my money. I wait for six days and after that time I no even hear anything from my bank, I go there go complain, This na for December last year, I don go there many times but nothing change she yarn.
ctress Gloria Young and wife of actor Nobert Young don explain why she fight for Bank becuase of N20,000 as she dey follow saturday Beats yarn. 

Now I don call my lawyer and hin don send dem letter. Hin dey follow dem dey talk but the bank dey beg instead make dem pay me my money. The matter for ground don dey too long and I don dey vex  because if my bank no fight for me for N20,000, na N1million dem go fit fight for? I go still send dem another letter from my lawyer she talk. Nawa ooo

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.