Sunday 26 July 2015

SEE WHY DEM CANCEL BIG BROTHER AFRICA 2015


This na bad news oo. According to the gist wey dey reach me now, the biggest reality show for Africa, Big Brother Africa fit no dey dey this year, even as fans don dey expect.
This na because of say dem no fit get sponsors wey go sponsor the show. The Organisers of the show, Mnet Africa and Endemol no fit get sponsors for this year own according to the gist.



The Managing director of Multichoice ghana, anne Sackey don yarn t peganews say for Multichoice  dem receive letter say this year Big Brother africa no go happen as e suppose dey again this year.
She yarn say MNET no give dem any reason why dem no go do this year award but she feel say na because dem never fit get any sponsors wey go sponsor the show and e go affect dem this year.

Nawa, abeg make dem go find sponsors o

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.