Tuesday 21 July 2015

PRESIDO BUHARI AND SARAKI NEVER SETTLE DEM WAHALA?


People wey think say the beef wey Presido Buhari and Senate Presido, Bukola Saraki don end go read this tori as shock.
Buhari and Saraki pray together for the Sallah holiday last week friday, July 17th but according to the tori na Saraki force dem make dem do the meeting.


According to the gist, the leaders for All Progressive Congress (APC)  don try to settle the problems but the two of dem no gree settle the wahala and dem don even give up. Saraki bin organise dinners to raise money for Buhari campaign. I hope say dem go settle am so that this country go move forward.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.