Tuesday 21 July 2015

JONATHAN FORMER CSO, GORDON OBUA STILL DEY ALIVE, DENY RUMOURS


Rumour start to spread today say former Presido Goodluck Jonathan CSO, Gordon Obua wey still dey work for hte SSS don die. The rumour na say hin die as hin SSS arrest am but hin don comot today to deny the rumours......
The former CSO do press conference this evening where hin yarn newsmen say hin still dey alive and nothing do am and SSS dey treat am fine and no problem.
Obua yarn for the office of SSS for Abuja today talk say since last week wey dem arrest nothing don do am. Hin yarn say hin dey there to just explain how hin take serve the former Presido and when hin explain say hin no dey wring, dem go release am.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.