Friday 10 July 2015

OGA PRESIDO MUHAMMADU BUHARI DON REJECT N400M CARS, E GO CONTINUE WITH THE GEJ CARS


presido Muhammadu Buhari don reject cars wey be N400M as hin no go change the cars wey former Presido, Goodluck Jonathan use according to the Nation Newspaper. The cars wey be N400M na customised armoured Mercedes Benz S-600 (V222) as dem be N80m for one.


 The Nation yarn say Presido Buhari hear about am frompermanent Secretary of of state house, Nebolisa Emodi. Hin yarn say hin dey okay with the ones wey former Presido, Dr. Goodluck Ebele Jonathan use.
Jonathan bin yarn say make na Buhari amke the decision as the tin come for the end of hin own administration as the cars go come for Buhari time.
 Presido Buhari don approve say make  the Permanent Secretary reduce the money wey dem dey spend for the state house, come add go the finance department.

Tori from the Nation.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.