Sunday 5 July 2015

NA THE REAL REASON WHY NFF SACK KESHI BE THIS?

According to wetin I hear from one of my padi for NFF, the former Super Eagles Captain go apply fot the Coach of Ivory coast and when NFF hear am, dem vex no be small. The job for Ivory coast don dey for some time and Keshi feel say na the best time to apply for the work be this, hin no know say NFF go catch am.
NFF don carry the Job give assistant coach Salisu Yusuf and Shuaibu Amodu till dem announce the new coach. This na the 3rd time wey Keshi and NFF dey separate since hin win the African Cup of Nations for South Africa for 2013 but this time, I dey almost sure anybody hin no go come back again until maybe after many years.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.