Monday 20 July 2015

33 OUT OF 36 NOMINEES FOR MINISTER DON FAIL CORRUPTION TEST



According to Sunday Tribune, e go tay before Presido Buhari go choose ministers because right now, nobody dey for ground and thats why oga Presido don postpone am to September. According to the tori, 33 out of 36 nominees fail the test wey the presido make dem do because hin wan choose people wey no dey corrupt.


APC send 36 names to the presido and after dem go for test for Department of State Security(DSS), Economic and Financial Crimes Commission (EFCC),Independent Corrupt Practices and other related offences Commission (ICPC), the Central Bank of Nigeria (CBN), theForce Criminal Investigations Department (FCID), and theDefence Intelligence Agency (DIA), na only three people fit pass the test.
Person wey dey there don yarn say Presido Buhari no wan carry anybody wey get any mago-mago or wey dey corrupt put as minister. Nawa oo

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.