Friday 1 May 2015

ALL THE PEOPLE WEY RUN LEAVE PDP GO RUN COME BACK WITH EMPTY BELLE----JONATHAN

Presido Goodluck Ebele Jonathan yesterday April 30 for Abuja as hin receice the PDP report of presido election campaign yarn say everybody wey run leave PDP go still use dem two leg waka come back with empty belle.
Hin yarn say PDP na still number one party for Naija and once time reach dem go come back to how dem dey before. Hin talk say that time PDP go look the side if people wey work the part before dem look the people wey run comot.

Hin come talk about why hin accept defeat. Jonathan yarn say him no call anybody before hin ask Buhari tell am congratolovia.
Hin talk say hin don pay the price for the whole PDP members even though some of dem don dey suffer for  wetin hin do.
Jonathan come talk say for the 2019 election PDP go come back and even though dem lose some governorship election and senator election too especially for North hin still believe say na dem be the party wey get mouth pass for Naija.


E-more

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.