Thursday 30 April 2015

NAIJA GOVERNMENT DON ASK FOR DEAD BODY OF THE 4 NIGERIANS WEY DEM KILL FOR INDONESIA

On Tuesday dem kill 4 Nigerians for Indonesia after dem talk say dem commit Drug trafficking. This na after President Goodluck Jonathan beg for dem, the Indonesia government wey don defend wetin dem do still kill dem.

Now Minister of Foreign Affairs don talk say the Naija government don ask the Indonesia government make dem send the body of the four Nigerians wey dem full names na Martin Anderson, Okwudili Oyatanze,
Jaminu Abashin and Sylvester Obiekwe.
The government don send message to the family of the men wey dem kill. Dem talk say dem go collect the dead body so that dem go bury dem well.
The men die for Nusakambangan island after dem shoot for firing squad.


E-more

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.