Monday, 27 April 2015

I GO INVESTIGATE SANUSI $20B WEY LOST----BUHARI

General Muhammad Buhari as hin dey talk on Sunday April 26 yarn say hin government go investigate the $20B wey former CBN governor and now Emir of kano, Sanusi Lamido Sanusi talk say don lost. Sanusi wey talk say the Money na from the money wey NNPC no return to Government account.

Hin talk am when hin campaign people from Adamawa state come visit am for Abuja. Hin yarn for Hausa say instead of make Jonathan to investigate the matter wey sanusi talk dem come sack am.

   "Una remember when former CBN
     sanusi talk say $20B lost. No be
     N20B na $20B na hin lost. Dem talk
      say na lie, and instead make dem
      investigate, dem sack Sanusi
      God come bless am, come make
       Emir of Kano, wey come be the tin
        wey hin want. Well, I wan tell una
         say my government go look the
         matter.


I like wetin Buhari dey talk and I want make dem dey return all the money wey lost. Sai Baba! Sai Buhari!!


E-more

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.