Sunday 12 July 2015

WHY? FORMER GOVERNOR ROTIMI AMAECHI AND PASTOR TUNDE BAKARE DEY FOLLOW PRESIDO BUHARI GO U.S THIS MONTH

Former rivers state governor, Chubuike Rotimi Amaechi and Pastor Tunde Bakare wey be Presido Buhari VP when hin contest for 2011 and the Senior pastor for Latter Rain Assembly go dey part of the 18 people wey go follow Buhari go America this month for July 20, for three days.
Five governors go join oga presido apart from the other 18 people, dem be Abiola Ajimobi (Oyo State), Rochas Okorocha (Imo State), Adams Oshiomhole (Edo State) and two others
Former member of the House of Representatives Farouk Adamu go join the Presidential team too with ogas dem for different ministries and top civil servants.
Why Amaechi and Bakare go follow Buhari, dem no be government workers or anything for any ministry, this na waste of money wey dem for use do beta thing for we country people.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.