Thursday 16 July 2015

SEE WETIN OGA PRESIDO BUHARI GO DO FOR U.S NEXT MONTH

The office oga Presido Buhari don announce wetin the Presido go do for America as hin dey ready to visit the country on sunday .
On Wednesday, July 15th dem yarn say the main thing wey hin dey go follow dem yarn about, na the problem of Boko Haram and terrorism as e take concern Naija and the whole Africa.
Special Adviser to the Presido for Media and publicity matter, mr. Femi adeshina yarn this one for the Press statement wey hin release to news people.


Adesina yarn say the Presido go meet with Presido Barack Obama and other top top government people wey dey there. Hin yarn say hin arrange  so that dem go yarn this terrorism issue wella.
After that one hin go see Chairman of the United States Joint Chiefs of Staff, Gen. Martin Dempsey and the Deputy Secretary of Defence, Robert Work, on military and defence cooperation.
 Apart from that one, hin go see US Secretary of State for the State Department for Washington DC, come later hold meetings with the US Senate and Congressional Committees on Foreign Relations, and the Black Caucus of the US House of Representatives.
Presiod Buahri go see the U.S chamber of Commerce and meet the VP, Joe Biden too to yarn more about how dem go beta Naija.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.