Tuesday 14 July 2015

GOVERNOR AMBODE HELP TO RESCUSE WOMAN WEY GET ACCIDENT FOR LAGOS YESTERDAY


Yesterday, July 13th, Lagos state Governor Mr Akinwumi Ambode help to rescue one accident Victim for Ikoyi area for Lagos. Miss Anukam Angela wey dey inside Toyota Corolla around 8: 15 a.m get accident after she lose control of her car for Osborne road, Ikoyi.

People wey dey there yarn say the governor come down from hin car to help the lady for her car wey no fi move and talk that time. Hin come ask the Ambulance wey dey for hin Convoy make dem look the woman. Hin talk say make dem treat the woman for Lagos Island General Hospital for free before dem discharge am.


No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.