Tuesday 14 July 2015

COOL FM OAP FREEZE FORMER WIFE DON FINALLY YARN ABOUT ALL THE THINGS WEY FREEZE TALK SAY SHE DO

See as dem look happy together.
Opeyemi Olarinde na the former wife of Cool FM OAP, Freeze wey hin talk say dey violent and she dey sleep with other men during dem Marriage wey last for 13 years.  She don finally talk about wetin Ifedayo Olarinde, A.K.A freeze accuse am of and whether na true.
 She yarn say she don get many calls from her friends and family members who wantalk about the things wey Freeze dey post for Instagram nowadays and the names hin dey call am.
She yarn say Freeze don try to spoil her name many times for Social media and for other places but she don yarn say she no talk or fight about am, because no be her character to fight.
Opeyemi deny wetin hin talk say she dey like to fight and sleep with other men, say she no be Adulteress as Oyibo people dey call am.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.