Tuesday 19 May 2015

SUPER FALCONS STELLA MBACHU REMIND PRESIDO JONATHAN ABOUT HIN AWC PROMISE

Super falcons star striker Stella Mbachu don remind Presido Goodluck Ebele Jonathan about hin promise to host the super falcons wey win the Africa women championship (AWC) before hin comot for power for May 29.

Seven months after dem win the cup, the girls never meet the presido with 10 days to the day wey hin go handover to APC Muhammad Buhari.
She yarn say if the presido no host dem before hin comot for power e go affect the players and dem no go get motivation for the World cup for Canada.
The super falcons wey beat Cameroon lionesses 2-0 for the final of the AWC go face USA, Sweden and Australia for group D for the World cup.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.