Monday 18 May 2015

MY WIFE NO BE MODEL---ADAMS OSHIOMOLE

Yesterday for the Thanksgiving service wey dem do for immaculate conception Cathedral for Auchi, Edo state governor Oshiomole deny say hin wife Lara na Model.
The governor yarn say hin don see all the newspaper tori wey dem write say hin marry "top model", hin think say dem dey talk about another person.
"The lady wey go send come my side and my hearr to marry no be model now and she no be model before". She look very beautiful maybe that's why people think say this kind person na model.But, of course, she be model to me and we dey pray and hope say we go be models for God eyes as that na the most important tin".
The governor come yarn say e no easy for am, say hin former wife die and say the new one wey hin marry no come to replace am.


No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.