Saturday 23 May 2015

MORE THAN 50 LEADERS DEY COME MAY 29 HANDOVER

Minister of culture and Tourism, Chief Edem Duke for press conference for Abuja don yarn about the plans wey the government get for the May 29 inauguration ceremony for Abuja.

The minister From Cross river state yarn say dem don invite More than 50 leaders of different countries. All the 54 countries don collect invitation and other top countries for Europe too. Hin yarn say more than 50 heads of states go come for the ceremony.
Talking about security matter, Chief Duke yarn say all the security people don start work and dem go make sure say nothing like wetin happen for 2010 independence day, happen again. You go remember say for Naija 50 years independence day celebration, bomb blow outside Eagle's square.
Some streets and roads for the FCT go close and dem go put screens for some places for Abuja so that people wey dem know invite go fit watch the ceremony.
Hin deny say the government go use N3b for the ceremony. Hin yarn say wetin dem go use no go reach N2B sef. Hin yarn say the ceremony go be one of the best for Naija.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.