Tuesday 19 May 2015

FORMER MBGN SYLVIA NDUKA WAN MARRY ALIKO DANGOTE, SHE DON CHANGE TO MUSLIM

Former most beautiful girl for Naija Sylvia Nduka go soon marry Africa richest man Aliko Dangote if we go believe the tori wey dey spread for internet.
Sylvia Nduka wey come from Anambra win MBGL girl for 2011 don change her name for instagram to "Sylvia Nduka AD" the AD mean Aliko dangote.

The tori never finish oooo...

Sylvia wey many people don dey talk say change her religion to Islam  because of the kind cloths she dey wear now.

She don dey enjoy life now well and she post this picture for inside this bathroom wey be like say na Dangote bathroom or for one expensive hotel and she don dey fly for private jets.

So make we expect another big Wedding for Naija.


No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.