I TOO KNOW meet with Mr Nigeria International as part of our new Interview series. The interview dey interesting as hin talk about hin struggle from normal guy to become mr nigeria international 2014, Hin love life and hin future plan.see the interview
ITK : Hello how you dey.
Henry: I dey fine my brother.
Henry: I dey fine my brother.
ITK: tell us about Henry pope before you win Mr Nigeria Intl 2014.
Henry: I just be one normal model.The tin wey I dey do that time pass na Runway.But,I bin want more so I start to dey do Pageantry.The first one wey I enter na Mr Anambra Universe wey I comot as 3rd runner up.This one give me the title "Model of Anambra 2014.Na this one give me the chance to represent Anambra for Nigeria International Supermodel.
ITK: interesting story, I like am say you no give up after Mr Anambra Universe.So how the journey wey you come use take be Mr Nigeria international.
Henry: My brother, e no easy Oo.I leave Anambra go Lagos.I get accident for road wey affect my eyes but God na God.The accident no too disturb.When I reach Camp e no easy,the rehearsal no be small.The time wey we sleep for camp no reach anything but e bin dey interesting. I meet beta people, and we I make beta friends dem.At the end of the day,dem crown me Mr Nigeria international 2014.
ITK: Nawa you try no be small.E dey normal say after you win,tons go change for your life.So how your life don change since you win?
Henry: NISM don change my life.I know wetin I want before the Pageant, and I get am.
ITK: So you think say you go win?
Henry: I work to win and I get the result.As I win my life change wella,as I become king dem gimme free wardrobe,help plan my life and e make me beta person.I drop some bad character and I don learn Poise and etiquette since I don turn Celeb.Dem give me focus and ofcourse the money wey I win.
ITK: lwkmd..you be proper Igbo man.
So wetin be the biggest tin wey you don get since you don turn king?
Henry: Chance to go Soweto, but I no fit go because I no well that time.
ITK: sorry Oo I dey sure say another go come.So wetin be your biggest challenge since you win?
Henry: To dey go school and to dey model,e no easy but I dey make am work.
ITK: You don think about say make you drop out?
Henry: Lie lie. e no dey possible.
ITK:How you dey handle the girls as fine boy?
Henry: Na you talk am oo.I dey handle the girls with respect.
ITK: You get anybody special for your life? You understand wetin n I dey talk?
Henry: e dey complicated.
ITK: so person dey?
Henry: No.
ITK: I hear say your mama,uti Nwachukwu and IK ogbonna na your role models, why?
Henry: Yea I like dem because dem dey creative.
ITK: so wetin go happen to Henry pope after hin hand over.
Henry: I go continue with my fashion line, I be fashion designer and the name of my fashion label na Henry Mannequin.
ITK: You get talent Oo. So wetin you think of I too know Naija.
Henry; I like itk naija, i dey follow am wella. I no fit spend one day make i no read am. I go tell everybody make dem read am because dem no wetin people dey want and an very young and creative guy, get am.
ITK: Advise to youths?
Henry: I go tell dem make dem no just talk about dem dream. I go advise dem make dem follow am and make sure say the whole world know de. No be the ast of Henry Pope be this you go dey see me, and na so I want make our Youths dey for better Naija.
ITK: Thank you for your time bro.
Henry; No wahala, anytime ITK Naija need me, I go show.
No comments:
Post a Comment
This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.
Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.