Thursday 12 March 2015

SEE THIS POEM FOR PIDGIN ENGLISH

I don see one website wey poems for pidgin english.
See this one:
Every where,
Even before before for Naija
Dem dey take honour
Tell country people
Wey do better thing dem
Well done.

Person do better sport
Dem go take honour
Tell am well done.
Person write better write write
Dem go take honour
Tell am well done.
Person play better politics
Dem go take honour
Tell am well done.
Person do better business
Na honour dem go take
Tell am well done.
Better every every
Dem go take honour say
Well done.

Now di moto don enter reverse,
Now
Naija dey dishonour honour.
Today dem go catch country person
Wey dey thief Naija money,
Tomorrow dem go carry am go court.
Next tomorrow
Court go give am bail,
Case file go waka,
Case go finish.

Next year
Di country person
Go show for honour,
Naija dey dishonour honour.
 
The person wey write am na Chidi Anthony opara see more for here

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.