Friday 12 December 2014

TOP 7 NAIJA ACTRESS FOR 2014

This na the official I too Know NAIJA top 7 actress wey do better work this year.


7. GENEVIEVE NNAJI

When we hear say Genevieve Nnaji go dey part of the people we go act for "Half Of A Yellow Sun" everybody no say she deserve am. She act as Ms Adebayo And she act for the film well well. The actress come end this year with her fashion collection with JUMIA "st Genevieve" this year don prove say she be mama.Genevieve don achieve many and this year she show am again.



 6.IRETI DOYLE

Mrs Ireti na one of the people wey don work hard pass this 2014. she continue the soap opera wey she dey do "Tinsel" and come add another one " Gidi up" wey don use nominate am for AMVCA award. She also bin do something wey no be all the actress dey do wey be stage play. She do plenty stage plays this year. she deserve this list abeg.

5.  MERCY JOHNSON

Mercy no do too much this year but she do two films this year wey make sense. The fist one na the one wey she act with Nse Ikpe Etim "I come to Lagos". The movie funny and na wetin den dey call comedy. The other film wey Mercy act this year wey make sense and na comedy to na . AY " 30 DAYS IN ATLANTA"
Mercy do some Normal home video wey dey good his year too, If mercy no dey this list people go kill me.


4.WERUCHE OPIA
Weruche Opia na one of the stars wey comot from "When Love Happens". she act like say tomorrow no dey. She do the role With all her mind. This role na in announce say na she be one of the next people wey go become celeb dem for this our industry. Weruche dey part of the Nominees for AMVCA. she deserve am

3. CLARION CHUKWURA
Clarion Chukwura na im be one of the biggest actress for our industry, and this year she kill am. The role wey she act for the movie "APAYE" no be small thing. This role na even make am win AMAA best actress. APAYE na one of the biggest movie and Clarion naa one of the biggest actress i no fit shout na she be oga.

2. BEVERLY NAYA
Beverly na one of the actress for our industry wey work pass this year. She act for one of the biggest film this year " WHEN LOVE HAPPENS". Beverly come out again for "TINSEL" wey dey like the biggest Soap Opera for Africa. She come do "MAKE A MOVE" ,small tin wey remain i for give am number one. Evry where u go dis year u go see Beverly Face. The girl idey too much.

1.  NSE-IKPE ETIM
If na by everything, Nse suppose be number one . Nse try this year and one of her film wey big this year na , the film wey she act with Mercy Johnson, "I COME TO LAGOS". Nse act this funny film wella. she come go another film "DEVIL IN THE DETAIL". she do "TUNNEL","GREEN EYED", "IN BETWEEN" etc. Nse try this year. She deserve am abeg.


2 comments:

  1. I agree with the list dey all did extremly well this year. Cant wait 4 next year

    ReplyDelete
  2. Shey una get respect for hia!!!! How Gene go dey 7...

    ReplyDelete

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.