Thursday 6 August 2015

I NO DEY CANCEL NYSC--- BUHARI



Presido Buhari Muhammadu don yarn say hin still believe say the National Youth Service Corps say dey useful for Naija so that people come together as one big happy country.

Preesido Buhari come talk say hin government and everybody wey dey for hin cabinet go try to make sure say dem do everything wey dem fit do to make the program continue.


Hin yarn this one after officials of the Federal Ministry of Youth Development wey dem leader na Permanent secretary, Mrs. Rapi Jimeta yarn am about the program and how the tin dey go.

When I go my house for Daura, I dey look for NYSC members from Lagos, Aba and other parts of the country and I dey always dey happy when I learn say apart from dem service some of dem never leave dem states to visit other parts of Naija.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.