Presido Buhari don release N2.9B for sports but before hin release the money hin give dem some conditions wey dem go use spend the money.
DG of national Sports commission Mallam Alhassan Yakmut yarn say the presido warn say any coach wey fail for the next All african games go get punishment. The All Africa games go happen this year for Congo.
The presido approve the money after dem agree say dem go torchlight all the money wey dem spend as hin dey take dey give dem the money. The N2.9B go cover the All african games and dem preparation for next year Olympics and the Commonwealth games.
No comments:
Post a Comment
This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.
Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.