Sunday 26 July 2015

I BE CHRISTIAN, NO PREACH TO ME ---- AFRO CANDY WARN PASTORS


Judith Chichi Opara Mazagwu wey many people know as Popular Pornstar wey dem dey call Afro candy don warn all the men of God and pastors.
She yarn for her Facebook page:


Befor una go my inbox come dey teach me about Jesus christ and how hin die for me and how hin love me, look me well, I be christian, I dey always prays and worship God and hin son Jesus Christ. I know say dem love me, protect and dey provide for me and my children, una no need to tell me.

Some of una go even go my website and after una don look all the nake pictures wey dey there before una start to preach to me. Make I warn you, my new style na say i go report una give una wives say make dem comot una since to block una no dey work again. When you reach your wife, you go explain how my website and my pages, dey like Church.

So my Advise na make una carry una hungry man body go meet Boko Haram preach to dem , since una wan preach.

Afrocandy

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.