Saturday 4 July 2015

AISHA BUHARI BEG NAIJA PEOPLE TO SUPPORT HER HUSBAND!!!!


The wife of Presido Buhari, Aisha Buhari son beg Naija people say make dem follow her husband work so that dem go fit rescue Naija from the situation wey the country dey now.

She dey yarn yesterday, Friday July 3, 2015 for the breaking of the Ramadan fast wey she organise for the less priviliged people inside the old Banquet Hall, for inside the Aso Rock villa, Abuja. Mrs Buhari use the opportunity to promise Naija people say her husband go bring beta come the country.


She yarn say ' I wan promise una say my husband, Presido Muhammadu Buhari go do everything wey hin fit do to make sure say sat the life of every person for Naija beta.'

'I wan thank all the people for all dem support for the support wey dem don give so far, wey dey very important for Naija to develop.

'You know say the nation dey suffer change of power and we need to get everybody support for this government to get success.'

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.