Wednesday 3 June 2015

LINDA IKEJI DEY NAKED FOR THIS THROWBACK PICTURE?



Wetin I no go hear?
I start work this morning after my 3 days break and my mail don full with message from some readers.
Some na about where I dey, while the others na different tori. The one wey surprise na this one about Linda ikeji wey the person call ' my rival'.




I go try to tell una wetin the person yarn because I no wan copy and paste the mail because her name dey all over.
She yarn say for one photo shoot and for this picture (for up), popular Naija blogger dey naked. She yarn say Linda yarn say she no wan wear anything so that she go dey more sexy for the picture. E never finish.... she swear say na true she dey yarn and if I check well I go see say na true.


See my reply ' my dear, first Linda ikeji no be my rival, infact na one of my mentors. Whether she no wear anything under I no know, but for the fact say she wear something ontop mean say she no dey naked, thank you and continue to dey read ITK naija'.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.