Tuesday 12 May 2015

LAGOS STATE PDP IMPEACH THEIR STATE CHAIRMAN

People's Democratic party (PDP), Lagos state chapter don sack dem chairman Capt. Tunji Shelle after the state no win any major position for the last election.

Apart from that one, the members don call Economic and financial crimes commission (EFCC) to start to investigate the former chairman say hin thief money and collect bribe. The members yarn say Shelle, no dey loyal to the party and hin dey support another party.
Many members of the party believe say shelle for the last election join hand with another party wey many people believe say na their main competition, APC so that the party no go win for Lagos.


E-more

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.