Sunday 10 May 2015

FUEL SCARCITY WAHALA! PT 1

Almost all the filling stations wey dey sell fuel, dem no dey sell with the normal N87 price per litre. Some dey sell reach N200 even though, black market now na N250 per litre.
Agege, Iyana-ipaja side for Lagos almost all the filling stations wey dey sell the sell am for N110 per litre.

Wetin surprise me be say, even as the price take high, people still dey buy and e be like say the queue dey increase. Some people dey spend pass 5 hours for the queue and still dem no buy. Person like me, i just drop my jerrican for the filling station, go sleep!

Area boys sef dey show their body too, dem go come scatter the queue, cause quarrel, so that dem go fit buy fuel and cheat the people wey don suffer since. Anyhow there is God!
We no fit wait for this new government and to see wetin dem go bring, I get this feeling say dem no go settle this fuel tin till after May 29.
I just dey talk my mind o


E-more

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.