Sunday 10 May 2015

COOL FM OAP CALL HIN FORMER WIFE "MONSTER" FOR INSTAGRAM

So see wetin happen, Freeze just celebrate hin birthday but e be like say today the Cool FM OAP just wan yab hin former wife.
Hin go hin instagram to thank God say the monster wey disturb hin life don comot. Hin just dey yab am and anybody wey read am go know say na hin former wife hin dey follow am talk.

If you still dey doubt say na she, dem marry for 15 years and freeze talk say the monster torment am for 15 years.

Freeze, if you want my advice, just forget about the woman and focus for your career and pikins.


E-more

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.