Friday 27 March 2015

WE GO FIGHT BUHARI,GUN FOR GUN,BOMB FOR BOMB--ASARI DOKUBO



Former Militant oga Alh Mujaid Asari Dokubo don talk say dem go fight General Muhammad Buhari gun for gun,bomb for bomb, bullet for bullet,if hin wan cause problem.Asari talk am for Niger Delta People Salvation Front rally for president Jonathan for Warri.
Hin talk say Buhari believe say naija people dey under am when hin dey rule and naija no want that kind person, people like that no suppose dey rule naija for this kind time again.
Asari come talk say people like Buhari suppose dey Prison because of the way hin treat naija people when hin bin dey rule naija from 83-85 and not to dey contest among people wey dem head correct.
Hin talk say make we kick Buhari comot, say na him be the main person wey dey support Boko Haram.
Asari Dokubo na former militant before former President Yar'adua government give am Amnesty.

E-more

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.