Dear Kcee,
I don dey follow your career since you dey Kcee Presh.That time you and your partner, dey dress fine and I swear una get swagg.
Since you leave your partner, come dey sing alone, I no know wetin happen. Your career don blow,Limpopo and Pull over dey everywhere, but I no understand your dressing.
You dey mix rubbish and you no know the cloth wey fit you.The glasses wey you dey where nowadays, nawa.
Kcee dey one wey pain me pass na the one wey you talk say you be "fashion icon".All this colour suit wey you dey wear dey like school uniform.
The one wey I hate pass na the one wey you wear with canvas like village hunter. I put the picture under.
God bless your career, but please go find better stylist.I wan see improvement Abeg.Thank you.
E-more
village man
ReplyDeletehe cant dress at all
ReplyDelete