Tuesday, 3 March 2015

OPEN LETTER TO KCEE

Dear Kcee,
I don dey follow your career since you dey Kcee Presh.That time you and your partner, dey dress fine and  I swear una get swagg.
Since you leave your partner, come dey sing alone, I no know wetin happen. Your career don blow,Limpopo and Pull over dey everywhere, but I no understand your dressing.
You dey mix rubbish and you no know the cloth wey fit you.The glasses wey you dey where nowadays, nawa.
Kcee dey one wey pain me pass na the one wey you talk say you be "fashion icon".All this colour suit wey you dey wear dey like school uniform.
The one wey I hate pass na the one wey you wear with canvas like village hunter. I put the picture under.
God bless your career, but please go find better stylist.I wan see improvement Abeg.Thank you.
                                         E-more

2 comments:

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.