Presido Muhammadu Buhari don yarn the head of Service of the Federation, Mr. Danladi Kifasi for we country say make hin release the N5Billion for the people wey Boko Haram don attack sharp sharp so that dem go fit start new life.
The N5 Billion Naira na for the Victims Support Fund and former Presido Goodluck Jonathan na hin promise the money around one year ago, Last year August. Presido Buhari give the order after hin yarn the Victims support people dem wey dem Oga na Theopilus Danjuma for the Villa for Abuja.
Danjuma yarn say out of the N55.92Billion wey dem promise for the fund-raising dinner last year, dem never collect N33.54Billion Naira.
No comments:
Post a Comment
This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.
Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.