Even though the government never announce am, some News people and especiall Newspaper The Nation don start to dey spread the tori say Presido Buhari don start to Negotiate with Boko Haram. According to the tori the government don get informate say some members of the terrorist group for other countries wan submit all the guns and bombs wey dem get and dey ready to stop the terrorism waka. Presido Buhari dey careful as hin no wan repeat the mistake wey Goodluck Jonathan do when hin be Presido.
Hin don yarn the people wey dey lead the Boko Haram negotiations say make dem make sure say the people wey dem dey follow Negotiate with na the real Boko Haram leaders as dem go screen dem after dem do dem investigations. The major tin wey the presido want na make dem release the Chibok girls apart from the other small small tins wey the government want.
No comments:
Post a Comment
This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.
Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.